logo
Select Language
Hindi
Bengali
Tamil
Telugu
Marathi
Gujarati
Kannada
Malayalam
Punjabi
Urdu
Oriya

Canada 2026-2027 immigration plan go reduce international workers and students, set new target for temporary residents

Canada through di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) don release dia 2026/2027 plan to reduce foreign workers and international students so dem go fit control dia immigration system.

Di Minister of Immigration, Refugees and Citizenship for Canada, Lena Metlege Diab, tok say di plan go help restore control of di immigration system and also bring am to sustainable level.

According to di document wey Canada immigration ministry make available, dem outline dia priorities and also di annual targets for permanent residents for di next three years.

For February 2026, di IRCC bin unveil new categories under di Express Entry system for international workers wey wan come work for di country.

Dem say di announcement of di 2026 express entry categories na to allow Canada invite candidates wey get skills and experience.

Howeva, for di new plan, dem go reduce di number of temporary residents including international workers and international students wey dem go allow into di kontri.

Number of temporary resident wey go arrive Canada go drop from 673,650 for 2025 to just 385,000 for 2026.

Dis show reduction for di number of new international students and temporary workers wey dey apply to enta Canada.

"We go make am easier for companies and communities to recruit and retain critical and innovative workers, including skilled trade pipo, health care professionals and experts for emerging technologies, to support our labour market need," Canada immigration minister tok.

Canada plan na to reduce di share of temporary residents wey dey Canada to 5% of di population by di end of 2026.

Dem also wan keep permanent resident admission for less dan 1% of Canada population annually beyond 2027, but also attract talent international workers.

4
142 views

Comment